Senior Pastor of Dunamis International Gospel Centre, Dr. Paul Enenche, don drop hot warning give Nigerians make dem shine eye well. According to am, all those online loan apps wey dey disturb pipu phone with shameful messages na pure “agents of devil” wey dey tie pipu with spirit of debt.
Him yarn say debt na chain wey fit cage man destiny and make person no fit move forward. He advise say instead of rushing to borrow from loan apps, pipu suppose look for legit hustle wey go free them from embarrassment.
Pastor Enenche even quote Bible say “borrower na slave to lender” – meaning anybody wey debt hook, na bondage dem dey inside.
Pastor Paul Enenche Fire Warning Against Loan Apps
Plenty Nigerians don complain tire about the way online loan apps dey disgrace people. Once you borrow small money and delay to pay, dem go begin send text to your family, friends and even neighbours, calling you thief.
Some victims don even talk say the trauma and shame don make them fall sick. Others dey complain say the interest wey dem dey charge na higher than ladder – before you pay one, another debt don land.
Pastor Enenche say na this kain oppression make am call the platforms “agents of devil,” because their mission na to trap pipu inside endless cycle of borrowing and disgrace.
Pastor Paul Enenche Advice Nigerians to Depend on God
The Dunamis pastor advise Nigerians make dem lean on God for provision instead of falling into debt trap. He encourage people to pray for wisdom, create small businesses, and trust say God go supply their needs.
He also warn say life no suppose dey built on debt, because once person dey owe, peace of mind go waka. Him words: “Better dey live small within your means than to borrow and live fake life.”
Many church members clap and shout “Amen” as he drop the advice, some even testify say once dem stop to dey borrow from loan apps, their life begin balance.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
