One 27-year-old man, Yayu Musa, allegedly kpai him mother-in-law, Madam Atayi Abdul, for her farm Na serious gbege shelle for Olla community wey dey for Omala Local Government Area of Kogi State. The mata shelle on Friday, and since then, the whole village never rest.
Dem talk say the guy carry woman go farm like say na normal farming waka, but the koko be say na trap e set. As dem reach bush, na so he use cutlass begin dey nack the 50-year-old woman like she be firewood. After the kpef, oga Musa sharply run comot go another village like say na film he dey act.
But village no be town wey person fit disappear. Local vigilante boys track am down like snake wey swallow another snake, come burst am for hideout. Na so dem carry am reach station with immediate effect.
Wetin Cause the Wahala: Na Baby Belle Wahala Turn Love to Gbege
According to one family member, Lawal Muhammed, the palava na because madam mama-in-law no gree make Yayu marry her daughter, Umi Idris. But during the main interrogation, Yayu vex talk say e be like say he don try everything to prove say he serious, but na so so insult him dey chop.
“My mother-in-law dey always tell me say I no be real man because my wife never carry belle. She even talk say she go give my woman to another man wey get better ‘cassava’ and money,” Yayu yarn. “I love this woman, I no want see her marry another man while I still dey alive.”
Yayu say he don sell him okada, spend all him small change just to make Umi get belle, but belle no gree show face. Still, the mama no reason am at all. E be like say the matter don dey pepper am for body, na im push am to go from ‘tired boyfriend’ to ‘bush cutlass commando.’
Na Love or Na Madness? Villagers Dey Confuse as Yayu Talk Say Na Love Push Am
Yayu talk say he love him wife scatter and no fit watch another man carry her like say she be bag of rice for discount. “I don suffer for this babe. From hospital to native doctor, I try make she get belle. I even sell my bike. But her mama no still gree,” he cry.
Many villagers dey wonder say, “Na love push am or na spiritual head reset?” Some people talk say even if belle no dey, k!lling no be the way. Others dey para say if na true love, e suppose get patience, no be cutlass.
Now, the matter dey police hand and serious investigation don start. But one thing sure — love wey carry cutlass no be love, na red flag wey don turn blood.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
